#EndSARS: Comedian Mr Macaroni Berates Celebrities For ‘Eating’ Govt Money

0
#OcuppyLagos: Mr Macaroni Reacts to His Arrest

Nigerian comedian Debo Adebayo, fondly known as Mr. Macaroni, has berated celebrities for being beneficiaries of the government, whom he claimed stifled activities of the #EndSARS anniversary.

In a lengthy Instagram post on Friday, the comedian spoke on how the government has clamped down on the events planned out one year after the protest.

The comedian, who was instrumental in the protests last year, called on the youths to unite towards making progress in governance.

His statement, majorly written in Pidgin, read, “I wan talk my mind as e dey pain me!! E don reach one year wey EndSars happen. Anytime wey people say dem wan do anything wey relate with Endsars for this Lagos; na so so Police Vans, Trucks, even Armor Tanks wey dem go pack full the place.

“This same Lagos wey dem go dey rob people for broad daylight and nobody will come to your rescue. Now October 20th is almost here.

“We say we wan do peaceful walk to Tollgate, dem say no. Oya make we do Summit for Landmark Event Center, in a controlled environment and discuss with ourselves, some powers above don threaten them.

“Those ones don talk say we no fit hold event there again. And how can anyone blame them honestly? Dem dey protect themselves, dem business and customers.

“My question is, can’t Nigerian Youths gather again to discuss the Way forward? Ok. Na una plan to rule forever be this??

 “Lagos State Government has an event this evening. Infact Top Celebrities go dey there to perform.

“Lagos state dey do show days before October 20th but other Lagosians can’t gather for their own peaceful summit?? Before I talk finish now, you go hear ‘they will hijack your summit’.

“So how Una dey do Una own shows and political rallies wey dem no dey Hijack am?

“For the celebrities, make we dey reason this thing. Government no good but una dey chop Government money.

“I no say make anybody no chop. But there are some things bigger than money!! If na Government wey dey treat the people better now, e for even better. People are suffering and these people are doing nothing about it!

“The last time wey police carry me, dem beat me and the others!! They stripped us Naked!! Dem dey ask me say “Sheyb na me wan dey disturb Governor Abi” Shey na that kain Government I go respect?

“If there will be any peaceful walk on the 20th, I’m still down. But it must be all of us together.

“E no go bad if Una go for the Government’s show and still attend a summit or take a walk for the youths. Everybody want Coconut Water but nobody want make dem break the coconut for their head.

“For Nigeria, even if you let them break Coconut on your head, powers above still fit no let the others drink the coconut water. We must all come together!” (sic).